News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

UCL highlights: Ronaldo score but United lose to Young Boys for Champions League

Video Archive
Wed, 15 Sep 2021 Source: BBC

Cristiano Ronaldo score on im Champions League return for Manchester United but e no dey enough as Young Boys score stoppage-time goal to win di match.

Dis na Ronaldo third goal in two games for di Red Devils since dem sign am from Juventus dis summer.

Ronaldo wey become di joint all-time Champions League appearance holder wit 177th appearance for di competition bin score early for first half of di game to give di English side di lead from assist from im kontri man Bruno Fernandes.

And dem bin dey control di game until Aaron Wan-Bissaka collect red card for bad tackle against Young Boys player Christopher Martins.

Di Red devils bin play for almost an hour wit 10 men.

Tori be say im bin look like say dem go hold on for a point afta Cameroon winger Moumi Ngamaleu bin equalise for di home team.

But everything change wen United substitute Jesse Lingard mistake backpass play in Jordan Siebatcheu wey wire hot short pass United goalkeeper David de Gea to give im side victory.

Di home fans celebrate wella afta di game while United manger Ole Gunnar Solskjaer bin look shocked.

Young Boys bin miss out on qualifying for di knockout stages of di competition last season.

Next up for United Group F match na against Villarreal for Old Trafford on 29 September for repeat of last season Europa League final.





Read full article

Source: BBC