Africa

News

Entertainment

Sports

Business

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

Nigeria student beats university lecturer into coma

Jailed Arms The accused is currently in police custody

Tue, 16 Nov 2021 Source: www.bbc.com

Management of Nigeria's University of Ilorin in the central Kwara State have reacted to an incident in which a student violently assaulted a lecturer.

A statement issued by the Vice Chancellor Dr. Fola Olowoleni sign, said the university had confirmed that the incident took place on Thursday, 11 November.

A Level 400 male student of the Department of Microbiology assaulted a female lecturer of his whose name was given as Mrs. Zakariyyah

The statement added that the security personnel at the time immediately took Salaudeen Wasiu Aanuoluwa into custody for questioning. He was, however, later handed over to the police for further investigate.

Di Academic Staff Union of Universities (ASUU), University of Ilorin (Unilorin) Chapter, don also condemn di attack on di female lecturer by di student.

Prof. Moyosore Ajao, di Chairman of di association follow tori pipo tok for Ilorin on Monday say dem no go allow di act go unaddressed.

"No be just because di lecturer na female but because she be human being and violence no dey tolerated for ASUU, more or less for one university wia character and learning be di essence of it.

"ASUU dey patiently wait on wetin di university management go do before we now apply our own action.

"But I fit tell una say di union no dey sleep on di mata and we no go allow dat kain mata to go under di carpet.", im tok.

'Why di student beat im lecturer?'

Dis na di question wey dey everybody mouth afta di video go viral on social media over di weekend.

From wetin we gather from di school authority, di tori be say di student allegedly attack di lecturer for inside her office.

Dis na sake of say she refuse to help am over im failure to do di mandatory Students Industrial Work Experience Scheme.

School authority say di lecturer don dey recover afta di ugly incident happun wey make dem rush her go hospital.

Di student papa also react

Di papa of Waliyu Anuoluwapo Salawudeen wey im nickname be Captain Walz say im no sabi wia all dis wahala dey come from wey im pikin go beat lecturer.

For one interview wey im do wit BBC Yoruba, Im tok say Waliyu younger brother bin first call di family attention to one incident wey happun on Wednesday, a day before im attack im lecturer.

"Im brother tell me say Waliyu comot from inside im apartment naked imsef for outside.

"I tell am make im find some pipo wey go hold am and I go come Ilorin di next day.

"On Thursday wen I reach Ilorin, I call im brother, na im tell me say Waliyu don go beat im lecturer."

Im papa add am say Waliyu no dey do like dis before, say e no get bad character for house.



Read full article

Source: www.bbc.com
Related Articles: