BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

ASUU go appeal court order to end strike

Professor Emmanuel Osodeke.png Professor Emmanuel Osodeke

Thu, 22 Sep 2022 Source: BBC

Di Academic Staff Union of Universities (ASUU) say dem go appeal di ruling of di National Industrial Court wey order dem to call off dia ongoing strike.

Di union president, Professor Emmanuel Osodeke reveal dis wen e appear on one live programme on Wednesday night.

E say di decision of di Inustrial court no be final.

''Di beauty of di Nigeria legal system be say steps dey. Indusrial court na di fisrt step, appeal court dey and supreme court also dey... definitely di decision of di industrial court no be final.'' E tok.

ASUU strike wey don pass seven months don continue to affect di kontri education.

Why ASUU dey strike

Di lecturers begin dia strike on 14, February over di controversy on di adoption of di Integrated Personnel Payroll Information System (IPPIS) of di goment as di payment system for di university sector, among oda issues.

Oga Femi Falana, wey be di counsel to di union, also confam dis on Wednesday hours after the ruling of di court, say e dey prepare di grounds of appeal.

ASUU strike wey don pass seven months don continue to affect di kontri education.

Di union also dey condemn di poor funding of universities, non-payment of salaries and allowances of some of dia colleagues, as well as di inability of goment inability to pay earned academic allowance to lecturers.

Several toktok don happun between di union and di goment but dem dey succesful- students don carry waka enta majors road in protest.

Di public universities lectureres dey demand di implementation of one agreement di federal goment sign wit dem for 2009 plus oda demands. One of di major issues wey dey block negotiation between goment delegates and ASUU na di payment platform.

ASUU dey insist say goment must use to take pay dem salary.

Di president of ASUU Emmanuel Osodeke say di National Information and Technology Development Agency (NITDA) wey suppose conduct integrity test on di University Transparency Accountability Solution (UTAS) don abandon am even afta dem upgrade di payment platform.

But Minister of Labour and Productivity, Chris Ngige say ASUU dey try prolong di strike by making negotiation impossible.

E explain give say why dem dey insist on UTAS even wen NITDA say e fail integrity test and pipo fit commit fraud on top di platform wey lead to huge moni.

Di rest of dia demands dey inside di 2009 agreement ASUU sign wit federal goment but ASUU say di goment still dey drag leg ontop di mata.



Read full article

Source: BBC