BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

Actor Yomi Gold announce separation from im wife

2cc88ab0 8b78 11ed 888e 5f7a68a59acb Nollywood actor Yomi Gold

Tue, 3 Jan 2023 Source: BBC

Nollywood actor Yomi Gold wey dey popular for Yourba feem don announce separation from im second wife, Meenah.

Di actor wey im real name na Yomi Alore say dem decide to go dia separate ways as love don die for dia relationship.

Dia separation dey come barely one year afta dia marriage.

Yomi wey announce di end of dia marriage on im verified Instagram account say na di two of dem decision and e want make dia families understand.

E post say “Wen love die for relationship, make nobody force am.”

E add say im wife, Meenah na beta pesin and no deserve man like am.  

“She go make a great and loving partner to a far beta pesin dan me.” E tok.

View this post on Instagram

A post shared by Yomi Gold Alore (@iamyomigold)



Di Nollywood actor marry Ameenah wey pipo sabi as Meenah for January 2022 for one coded wedding and dis go be im second marriage.

Yomi for im break-up post say im no dey perfect but go work on imself to be a beta pesin.

Wetin to know Yomi Gold and Meenah

Yomi Gold don feature for plenty Yoruba movies before e relocate go US wia e base now.

Dem born am on April 16, 1980. E come from Ilorin, Kwara State, North-Central Nigeria.

Apart from acting, Yomi also na business man.

Afta im nearly 15-year-old marriage to Victoria Ige end, e bin marry di up-and-coming actress, Ameenat aka Meenah for inside one coded wedding.

Di actor and im first wife bin go dia separate ways for 2018.



Read full article

Source: BBC