BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

Areas wia Nigeria military do operation for southeastern Imo state

Nigeria Army Mourns Members of di Nigerian Army

Wed, 13 Oct 2021 Source: BBC

Imo state south east Nigeria don dey news in recent months sake of di military operations wey don happun for different parts of di state at different times for 2021.

Tension for di state bin enta anoda level on 12 October, afta some men of di Nigerian military allegedly invade oil community of Izombe town for Oguta local goment area of di state.

Di military go do alleged revenge attack on Friday 8 of October afta some bandits wey wan do illegal bunkering launch attacks on some military posts wey dey block dia operations.

Di soldiers burn down about 80 houses, many car plus properties and tori be say three pipo die for di clash.

First na Orlu for 18 February, den continue for Orsu Ihitte Ukwa on di 19 of February.

Di Nigeria army deploy helicopters go Orlu for operations afta di military intelligence wey dem receive.

Army tok-tok pesin of di 34 artillery Brigade, Obinze, Owerri, Imo state, Babatunde Zubairu, say dia officer go Orlu but dem on harass anybody.

Di military cari out operation for for Orlu and Orsu local goments to search for camps of Eastern Security Network wey dey connected wit proscribed Indigenous Pipo of Biafra.

Goment of Imo state bin invite di military for February to di state to help stop di violence wey militants dey cause as dem dey kidnap and kill pipo.

Imo state govnor Hope Uzodinma say "dis militants come out and begin to shoot. We don lose lives, dem kill market women, rape old women for Orlu area of Imo State and they visited this serious terror on the citizenry."



Read full article

Source: BBC