BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

BBNaija: Jackie B, Jaypaul be Head of House for Shine Ya Eyes Big Brother House

 120335454 Bbnaijajackiebjaypaulbeheadofhousesametimeforshineyaeyesbigbrotherhouse.png Jackie B and Jaypaul

Mon, 30 Aug 2021 Source: BBC

Big Brother Naija housemates Jakie B and Jaypaul don become new HOH for di reality show.

Di two beat other housemates to find di most keys and finish dia task for dis week game.

Jackie B and Jaypaul na di number 6 and 7 pesins to sit for di Head of House throne wey come wit immunity from eviction package for di week plus oda benefit.

Di housemates wey don since enjoy di privilege na Peace, Boma, Pere, Maria and Liquorose.

Dis week HOH game bin come wit a twist as Biggie announce earlier say dem go get 2 winners e no dey clear why but to every game na im unexpected features wey dey make am dey interesting.

Biggie call di new twist 'The double heads of House'. And e tok say di rest of di house go get nomination and therefore go dey up for eviction.

So far, out of di 26 housemates wey start di reality show some weeks ago, 9 of dem don carry dia load comot from di house.

Only one pesin go dey eligible to go home wit di 90million overall winner price.

Highlight of di game

Na Queen be di first housemates to find more than one key during di game.

Boma become di first male housemates to finish di challenge.

But later Jaypaul overtake Boma to gbab di fastest time for di challenge.

Tega follow Boma for back to become di first female to complete di challenge.

Jackie B also break record to find di keys and still get di fastest time so far among di ladies.

Michael bin search but im no find any of di keys.

No be only Michael, Cross also enta di game and comot without any key.

Yousef bin dey inside di pool wen time run against am.

Whitemoney find just one key



Read full article

Source: BBC