BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

BBNaija Nominated housemates: Angel, Emmanuel and three oda housemates dey up for eviction

 120534213 Cbf52891 Ab44 41a9 918f 091fcf73f7fc Housemates nominated for eviction: Nini, Sasky, Yousef, Angel and Emmanuel

Tue, 14 Sep 2021 Source: BBC

Dis week five possible housemates dey up for possible evictions afta Monday evening nomination.

Di housemates wey dey up for possible eviction dis week na Nini, Sasky, Yousef, Angel and Emmanuel.

But dis names fit change afta di head of house games.

Dat na because Biggie, give dem one more opportunity to remove themselves from di list if dem win di HOH games or get di Veto power.

So for now na di housemates wey no dey up for possible eviction na Pere, Cross, Liquorose, Saga, Whitemoney and Queen.

Atleast one of di nominated housemates go leave di house on Sunday during di eviction show.

On Sunday di housemates bin say bye-bye to Jaypaul and JackieB afta dem get di least amount of votes from di viewers.



Read full article

Source: BBC