BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

Boris Johnson: UK Prime Minister and Sunak to chop fine over lockdown parties

Boris Johnson Prime Minister Boris Johnson

Tue, 12 Apr 2022 Source: BBC

Prime Minister Boris Johnson and Chancellor Rishi Sunak go chop fine from di police sake of dem attend party during lockdown.

Di Metropolitan Police bin dey investigate12 party wey bin shelle for Downing Street and Whitehall wey dem allege say don break Covid rules.

So far,dem don sama total of more dan 50 fines sake of Covid law-breaking for government buildings.

No 10 bin confam say di two of dem get notice from di Metropolitan Police say dem go give dem fixed penalty notice.

But one tok-tok pesin say dem neva tell dem di party wey di fine dey for.

Di force dey investigate allege Covid law-breaking for 12 gatherings for Whitehall and Downing Street.

Di police say dem no go tok di names of pipo wey chop di fines, but di goment promise to reveal if Mr Johnson and Mr Sunak dey among dem.

Labour leader Sir Keir Starmer say: "Boris Johnson and Rishi Sunak don break di law and repeat lie-lie to di British public. Dey must both resign.

"Di Conservatives dey totally unfit to govern. Britain deserve better."



Read full article

Source: BBC