BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

COVID-19 vaccine: Nigeria latest travel protocol for foreign travellers

 113283592 79b88d8d 04bc 4eb5 972f 5d8e9d62838d Temperature check for pesin wey arrive at one Nigeria airport | File photo

Sun, 17 Oct 2021 Source: BBC

Nigeria goment don release di revised travel protocol wey go take effect from Monday, 25, October, 2021.

Chairman of di Presidential Steering Committee/ Secretary to di Government of di Federation, Boss Mustapha, na im sign di statement dem release.

From Monday, travellers wey dey arrive Nigeria must present negative Covid-19 PCR test result wey dem conduct not more dan 72 hours before boarding.

Oda tins wey dey di travel protocol

  • Unvaccinated and partially vaccinated inbound passengers go dey required to observe a mandatory 7-day self-isolation in addition to a Covid-19 PCR test on day 2 and 7 afta arrival.


  • Fully vaccinated inbound passengers no go dey required to observe di mandatory seven-days self-isolation but dem go dey require to do a Covid-19 PCR test on day 2 of arrival.
  • Pesins wey dey arrive on "Business" trip or on official duty wey dey stay less dan 7 days in Nigeria must be fully vaccinated,


  • Produce negative Covid-19 PCR result 72hours before boarding; and


  • Conduct PCR test on day 2 of dia arrival.


  • Di PSC Chairman, Boss Mustapha, bin don tok during di national briefing, say dem go publish a revised travel protocol. Di review of di protocol dey based on science, national experience, and global developments.



    Read full article
    Source: BBC
    Related Articles: