BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

TV

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

Equatorial Guinea fit close down London embassy sake of VP sanction - See wetin cause kasala

 119579411 Gettyimages 479549439 Teodorin Obiang Mangue wey bi son of Equatorial Guinea presido na him be di vice presido too

Tue, 27 Jul 2021 Source: BBC

Di foreign minister of Equatorial Guinea Simeon Oyono Esono don tell state television say dem wan close di kontri embassy for London as response to di sanction wey Britain sama di president son.

One embassy official however tell BBC say di place remain open and e no know about any decision to close am down.

Last week, London impose asset freeze and travel ban on Vice-President Teodoro Obiang Mangue - and accuse am of using public money to fund big lifestyle.

Dis include spending half a billion dollars to buy mansions around di world, cars, one private jet and memorabilia of di pop star Michael Jackson.

Reports say oga Mangue bin spend £199,000 ($275,000) take buy glove wey late Michael Jackson bin dey wear.

E dey among five pipo to receive new UK "anti-corruption" sanctions.

Di goment of Equatorial Guinea describe di sanctions as illegal and based on lies.

UK Foreign Secretary Dominic Raab say di new sanctions na to target "individuals wey don pack money full dia own pockets at di expense of dia itizens".

Di four oda targets na from Zimbabwe, Venezuela and Iraq.

"Di UK dey committed to fight di blight of corruption and holding those responsible for di bad effect to account," oga Raab tok.

"Corruption dey drain di wealth of poorer nations, keep dia pipo trapped in poverty and poisons di well of democracy."

Di sanctions go help UK impose asset freezes and travel bans to prevent those pipo wey dey send money through UK banks or from entering di kontri.

Oga Obiang Mangue na di son of Equatorial Guinea president Teodoro Obiang Nguema Mbasogo wey don be president of di kontri for more than 40 years.

Dey appoint Obiang Mangue as goment minister for 1998.



Read full article

Source: BBC
Related Articles: