BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

Full list of media stations NBC revoke dia license and why dem fit go off air

Blocked Media Houses.png Balarabe Ilelah

Sat, 20 Aug 2022 Source: BBC

Fifty-two National broadcasting stations go stop to operate for different cities across di kontri.

Di National Broadcasting Commission (NBC ) revoke di licences today for Abuja, di Nigeria Capital.

Director General of di Commission, Balarabe Ilelah tell tori pipo for one press conference say di affected stations no gree keep to di three-month notice wey dem give dem to renew dia licences.

NBC say dem go shut down di stations wey dey affected within 24 hours.

'Di operation of di debtor-stations dey illegal'

For May 2022, di National Broadcasting Commission (NBC) publish for National Newspaper, di list of broadcast stations wey dey owe credit, wey neva pay di Commission.

Di Director General explain say dem give di stations  two weeks to renew dia license and pay dia debts or dem go revoke dia license plus withdraw dia frequencies.

E add say dem go give di withdrawn frequencies to oda pipo wey dey ready to abide by di necessary requirements.

 "Three months afta di publication, some stations neva still pay dia outstanding debts, in contravention of di National Broadcasting Commission Act CAP N11, Laws of di Federation of Nigeria, 2004, particularly section 10(a) of di third schedule of di Act".

"In view of dis development, di continued operation of di debtor-stations dey illegal and constitutes a threat to national security" e tok

Oga Balarabe Ileha say afta due consideration, di NBC no get choice but to announce di revocation of di license of di stations and give dem 24 hours to shut down dia operations.

List of Stations NBC release say e dey affected

Oga Balarabe  order di NBC offices nationwide to joinbodi wit security agencies to make sure say dem comply sharp sharp.

·  Silverbird   TV (Silverbird Communications  Co. Ltd) Network

·  Rhythm FM   (Silverbird Communications Ltd) FM Abuja

·  Rhythm FM   (Silverbird Communications Ltd) FM Lagos

·  Rhythm FM   (Silverbird Communications Ltd) Yenagoa

·  Rhythm FM   (Silverbird Communications Ltd) Port-Harcourt

·  Rhythm FM   (Silverbird Communications Ltd) Jos

·  Rhythm FM   (Silverbird Communication Ltd) Benin

·  AIT/Ray   Power FM (DAAR Communication ltd) Network

·  Greetings   FM (Greetings Media Ltd) Network  

·  Tao FM   (Ovidi CommunicationS Ltd) Okene

·  Zuma FM (Zuma   FM Ltd) Suleja

·  Crowther   FM (Crowther Communications Ltd) Abuja

·  We FM (Kings   Broadcasting Ltd) Benin

·  Linksman   International ltd Keffi

·  Bomay   Broadcasting Services ltd Abuja

·  MITV (Murhi   International Group Ltd)  Ibadan

·  Classic  FM (Pinkt Nigeria Ltd) Port-Harcourt

·  Classic  FM (Pinkt Nigeria Ltd) Lagos

·  Classic  TV (Pinkt Nigeria Ltd) Lagos

·  Beat FM (Megalectrics LTD) Lagos

·  Cooper Communications  ltd Lagos

·  Splash FM  (West Midlands Ltd) Ibadan

·  Rock City  FM (Boot Communications ltd) Abeokuta

·  Family FM  (Kalaks Investments Nig. Ltd) Ilugun

·  Space FM  (Creazioni Nig. Ltd) Ibadan

·  Radio  Jeremi (Radio Jeremi ltd) Effurun

·  Breeze FM  (Bays Water ltd) Akure

·  Vibes FM  (Vibes Communication ltd) Benin

·  Family   Love FM (Multimesh Broadcasting Co. Ltd) Port-Harcourt

·  Wave FM   (South Atlantic Media ltd) Port-Harcourt

·  Kogi  State Broadcasting Corporation

·  Kwara State Broadcasting Corporation

·  Niger State Broadcasting Corporation

·  Gombe State Broadcasting Corporation 

·  Lagos State Broadcasting Corporation

·  Lagos DSB

·  Osun State Broadcasting Corporation

·  Ogun State Broadcasting Corporation

·  Ondo State Broadcasting Corporation

·  Rivers State Broadcasting Corporation

·  Bayelsa State Broadcasting Corporation

·  Cross  River State Broadcasting Corporation

·  Imo State  Broadcasting Corporation

·  Anambra State Broadcasting Corporation

·  Borno State Broadcasting Corporation

·  Yobe State Broadcasting Corporation

·  Sokoto State Broadcasting Corporation

·  Zamfara State Broadcasting Corporation

·  Kebbi State Broadcasting Corporation

·  Jigawa State Broadcasting Corporation

·  Kaduna State Broadcasting Corporation

·  Katsina State Broadcasting Corporation

 NBC also draw ear say di Broadcast stations wey neva renew dia license for di current duration make dem dem do am within di next 30 days to avoid sanctions.

Di Commission also call on all IPTV (Internet Protocol Television) and oda broadcast stations wey dey  stream online to register wit dem to avoid disconnection.

E draw ear for Broadcasters say DTT or FM license no give dem permission to stream online, e explain say di two licences no be di same.  



Read full article

Source: BBC