BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

Ghana Population Census 2021: GSS extend census afta public outcry

Kobina Annim GSS111 Prof Samuel Kobina Annim na di govment statistician

Tue, 13 Jul 2021 Source: BBC

Over two thousand residents for Ghana bombard de Statistical Service with calls to complain say nobody count dem durimh de 2021 Population and Housing Census wey yeste, July, 11.

Chaw people also enter social media to raise concerns say no official count dem as part of de 2021 Population and Housing Census.

BBC Pidgin reach Dr Pearl Kyei, GSS official on dis matter who confirm say dem receive similar concerns which dem dey address.

Inside statement wey dem share, dem explain say "de call centre received over 2,000 calls from de public with concerns say dem no listed or enumerated dem."

Census Extension

According to de Ghana Statistical Service, sake of de challenge for some regions like Accra dem dey extend de enumeration by another 7 days, from July 12 to July 18.

Dem explain say dem receive data on 80% of de expected households by day 12 of de enumeration.

Out of dis, dem gather over 80% data on 12 out of de 16 regions, while places like North East record 97% while Accra record just 55% data on households.

Challenges

According to Statistical Service, de interest of de general public be high, but dem encounter some challenges.

One major problem be de transmission of data electronically to Headquarters as some areas, officials no fit transmit dema data sake of poor internet connectivity.

In some areas too entire communities no want participate in de census sake of boundary issues, also dem no fit reach some respondents sake of dem dey leave go work early, return home late, dem dey farm den stuff.

Ghana Statistical Service encourage members of de general public say dem for call dema advertised toll free numbers if officials no count dem in order to be counted.



Read full article

Source: BBC