BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

Ghana pastor clarify say daughter $1 million wedding gift na 'faith cheque' after tax office chase am

 119517409 43d51ba9 D683 4428 Bc05 8505f869e4fb Samuel Nana Nimo marry Naa Dromo inside white wedding on Saturday, July 10, 2021

Thu, 22 Jul 2021 Source: BBC

Top Ghana pastor come out to clarify say $1 million dollar gift check wey en daughter received during wedding no be real money.

Rev. Sam Korankye Ankrah, leader of Royalhouse Chapel International make dis clarification after Ghana Revenue Authority (GRA) chase en daughter for tax on de monies.

He explain say, some friends of de bride present dummy cheque to am during de wedding, but people mistaken dat for real money.

Sake of dis, GRA too follow up on dis matter to make sure say dem pay tax in de monies.

Inside letter wey GRA address to de bride, Naa Dromo, dem note say "information available to GRA show say you receive $1 million dollars as gift from friends. We dey invite you on 23rd July, 2021 at 10am for discussion on dis matter," dem add.

Background to wedding

Dr Samuel Nana Nimo marry Naa Dromo inside white wedding on Saturday, July 10, 2021.

De wedding which go viral sake of how flamboyant e be, turn de talk of town after some friends submit de $1 million gift cheque.

Some friends of Naa Dromo inside viral video present de dummy check.

In de process, one of de ladies collect microphone talk say in de past, dem dey gift household, kitchen items den stuff but now dem go higher.

Per de GRA letter, Naa Dromo for meet dem on July 23 where dem go discuss de matter and way forward.



Read full article

Source: BBC