BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

Goodluck Jonathan APC 2023: former president reject All Progressives Party presidential form group buy for am

Goodluck Jonathan Gj Goodluck Jonathan

Tue, 10 May 2022 Source: BBC

Nigeria former president Goodluck Jonathan don reject and rubbish di presidential nomination form wey one group bin buy for am.

Inside statement wey im Media Adviser Ikechukwu Eze sign, e say, e no dey aware and e no sign am.

"E don come to our notice say one group buy Presidential Nomination and Expression of Interest forms, of di All Progressives Congress APC, in di name of former President Dr. Goodluck Ebele Jonathan.

We wish to categorically say Dr. Jonathan no dey aware of dis bid and e no authorize am. We wan state say if di former President wan to contest an election, e go make im intentions clear to di public and no go enta through di back door." Di statement tok.

Di statement also tok say Jonathan never decide weda e go contest or not.

"While we appreciate di ogbonge request by some Nigerians, for Dr. Jonathan to make imself available for di 2023 Presidential election, we wish to state say e never in anyway, commit imself to dis request.

"To buy a presidential aspiration form in di name Dr. Jonathan without im consent, knowing di position wey e don hold for di kontri dey considered as an insult to im pesin. Di general public dey herefore advised to disregard am," di statement add.



Read full article

Source: BBC