BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

How rogue police behind bullion van robbery pay tribute to fellow officer wey dem kill last year

 123632789 Picture5 Suspect Constable Reindolph Gyimah Ansah

Thu, 10 Mar 2022 Source: BBC

Ghanaians dey inside state of shock after news emerge say some police officers dey behind de series of bullion van robberies.

But new information about how one officer who play key role in de robberies, enter Facebook to mourn de death of officer wey dey protect de bullion van dey burst mind.

One of de suspects, Constable Reindolph Gyimah Ansah wey police name as part of de bullion van robbers bin share condolences message give Constable Emmanuel Osei.

Dis be after dem kill am for Adedenkpo, Jamestown inside Accra.

"U still dey in my heart forever"

Evidence of de Facebook post wey rogue officer, Constable Reindolph Gyimah Ansah share Facebook pop up.

"U still dey ma heart forever. Jag guide ur soul. Rip Osei" he write for July, 2021.

De policeman wey share message of condolences give Constable Emmanuel Osei who dem kill during dia bullion van robberies also die.

Dis be after police announce say he die during shootout.

Director of Public Affairs, DCOP Kwesi Ofori explain say exchange of gunshots happen during de raid, wey two policemen, No.58284 Constable Reindolph Gyimah Ansah den No. 53549 Lance Corporal Stephen Kwaku Nyame wey dem arrest earlier in connection with de Bullion Van Robberies chop bullet den die.



Read full article

Source: BBC
Related Articles: