BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

Jackie B latest buzz for BBNaija 'Shine Ya Eyes' House

 119568818 Jackiebbnaijacapture BBNaija housemate Jackie B

Tue, 24 Aug 2021 Source: BBC

BBNaija Season six, don dey ginger for sometime now but be like anoda housemate don start to dey focus to give ogbonge ship and drama content.

And dat pesin na Jackie B. Recently di 29 year old bin get gist with White Money, Boma and Michael.

But make we start with di latest. Afta di Saturday night party, Jackie B and Michael bin siddon to analyse wetin dem be with each other for di house.

Dis na wen Jackie B tok say she bin care about Michael well-well wen she enta di house, howeva following di kwente wey dem bin get with di week, she say she "care less".

Jackie B bin dey vex at some point say Michael push am wen dem bin dey try settle Pere and Whitemoney beef and also how Michael bin dey hangout with anoda housemate wey dem call Angel.

But sha-sha dem settle dia wahala but before that one happun anoda bombshell drop.

WhiteMoney tok say im like Jackie B!

As per say she don tok before say ship neva dey with Michael as e dey one year younger than di mama of one, Jackie B say e bin no know say na how Whitemoney dey feel.

She further add say she go need to reset her mind to think of Whitemoney like that on top say na WhiteMoney be di kain pesin wey she go like date.

Jackie B don be di ship queen for dis season as fans of di show don link am with Boma, Michael and now WhiteMoney.

For di beginning of di show, she and Boma dey close sotay wen e win Head of House for second week, im ask am to be im Depity.

Even now wey Boma be Deputy to Maria, Jackie B still be di pesin wey im give im pass to come visit am for Head of Hose room.

But di tori change wen Michael enta di hose for third week cos as Jackie B tok am, "I bin care about you (Michael) well-well from di day wey you enta dis house."



Read full article

Source: BBC