BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

Kemi Adeosun no need NYSC certificate - Nigeria court tok as dem rule ontop her case

 119301560 57754424 Former Minister of Finance for Nigeria, Kemi Adeosun

Thu, 8 Jul 2021 Source: BBC

One Federal High Court for Abuja don clear Nigeria former minister of finance, Kemi Adeosun of National Youth Service Corps (NYSC) certificate forgery controversy.

Justice Taiwo Taiwo rule on Wednesday say Adeosun - wey resign ontop di scandal for 2018 - no need NYSC certificate to serve for political office.

Dat year, accusation begin fly upandan say di minister tender fake NYSC certificate as part of her qualifications.

NYSC na compulsory one-year service wey all graduates of tertiary constitution must serve for Nigeria. After di completion, di ‘corper’ go collect certificate.

Exemption dey for anyone wey graduate under 30 years of age. And na dis exemption certificate Adesoun chop accuse say she forge.

Di court also rule wen di former minister graduate say she bin dey 22 years old and she no qualify to participate as she hold British citizenship because di 1979 constitution wey dey active dat time, no require non-Nigerians to serve.

Justice Taiwo Taiwo also say di constitution no require her to present her first-degree certificate, or any oda certificate, including NYSC certificate, in order to collect appointment as minister.

Adeosun wey be former banker bin resign her ministerial position for September 2018. She say some pipo mislead her to believe say di certificate she collect wen she come Nigeria, na original one.



Read full article

Source: BBC