Reactions don full social media to di tori of one new feem wey Nigerian feem maker, Mo Abudu wan do based on di 'Yahoo-Yahoo' life of Ramon 'Hushpuppi' Abbas.
Hushpuppi na di Nigerian social media influencer wey di US Department of Justice announce for July say, e plead guilty to charge of 'conspiracy to engage in money laundering'.
Afta Mo Abudu di oga of Lagos-based EbonyLife Studios post for social media about plans to produce feem based on Hushpuppi, some pipo ask her why she no torchlight feem based on di EndSARS protests, wey dis pipo feel say dey more relevant.
Odas don criticise madam Abudu we be ogbonge feem and TV producer say she wan do di feem now because e go hard for Hushpuppi to claim royalty ontop di production.
Still, e look like say all don set for di feem ontop how Hushpuppi begin humble life for slums for Lagos, to wen e become wealthy and famous, to how e enter FBI net for Dubai, as 20 years prison sentence dey hang over im head now.
Social media reactions
5 tins to sabi Mo Abudu 'Hushpuppi' feem
Abudu for Instagram give reason for why she wan do di feem - like say she don know say pipo go kweshion her ontop am. She say "many lessons dey to learn from good and bad tori dem".
"And to make sure say di tori dey told with originality, na Nigerian storyteller with our kain pedigree need to dey involved... di film go give us chance to tell tori about how pesin character fit dey influenced by im environment and life choices," Abudu wey dem born and train for UK tok.
Read full article