BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

Nigeria security forces engage gunmen wey attack prison for Plateau State

 121206101 Bbc Nigeria Interior Minister (in ahite) wit some senior prison officers

Sun, 28 Nov 2021 Source: BBC

Gunmen wey come attack di Medium Security Custodial Centre for Jos, Plateau State don hook for dia according to statement from authorities.

Di statement wey di tok-tok pesin for di correctional facility OF Enobore sign, di gunmen land di Custodial Center around 5:20pm and immediately head for di main gate where dem engage di armed squad personnel for gun battle before dem break enta di yard.

Di statement add say although dem gain entrance to di yard, dem don trap inside as dem deploy men from sister security services to assist to lock down di entire area.

One eyewitness tell BBC Pidgin say dem plenty wey come.

"I see pipo dey run, you know say dis na festive season and you fit dey hear knock-out sound, but dis one dey different. Dem dey in dia hundreds and dem dey run, some dey young, some old and some dey in di middle.

I see one wey dem shoot for hand as e dey try to cover am, Some run come our house side dey look for where to hide, say make we hide dem. Di barracks no dey fenced. Some don go di river side wey dey for di barracks, some dey hide for inside di bush.



Read full article

Source: BBC