Di Economic Financial Crimes Commission EFCC say Obinna Iyiegbu wey many pipo sabi as Obi Cubana still dey wit dem.
Dis dey come afta tori begin spread on Tuesday say e don dey released.
Di Nigeria corruption police later clear di mata to BBC Pidgin for Tuesday evening say Obi Cubana still dey dia office.
Earlier in di day, one message from im verified Instagram account add to di tori wey fly up and down say e EFCC don free am.
Di message read as "Okpataozuore! I love you all! Unbroken!" bin generate thousands of comments few minutes afta e dey posted.
Plenty pipo wey react to di post including celebrities wey show am love and support wit dia comments.
When BBC Pidgin confam Obi Cubana PA to confam if true-true e don dey release, she say she no fit comment on di mata.
Na on Monday, Obi Cubana show for EFCC office.
According to one source from di agency, e tell BBC Pidgin say dem no arrest Obi Cubana as tori pipo bin report as na only di business man come dia office by imsef afta di commission invite am;
"We no arrest Obi Cubana. We don bin invite am come our office two weeks ago and e show up just yesterday around 11: AM by imsef for our office wey dey Wuse Zone 6 Abuja," di source tok.
Di source inside EFCC say dem dey investigate Obi Cubana for Evasion of Tax by di Cubana group.
Oda charges wey dem dey torchlight di business man for na; Money Laundering and Abuse of di Naira in public places.
E no dey clear if di abuse of di naira charges dey related to di spraying of money wey happun during di burial of di mama of Obi Cubana for July dis year.
Seven things to sabi about Obi Cubana
Obinna Iyiegbu aka Obi Cubana na businessman, entertainer, entrepreneur plus philanthropist dey for di custody of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC).
E enta limelight during di burial of ceremony of im mama, Mrs Uche Mabel Uyiegbu wey take place for im home town for Oba, Idemili South Local Goment Area of Anambra State.
Read full article
- Corruption has broken jail, running amok under Akufo-Addo - Mahama
- SML/GRA contract controversy: National interest must prevail — Prof. Seidu Alidu
- SML/GRA contract controversy: National interest must prevail - Prof. Seidu Alidu
- Housing Minister took US$20K bribes whiles at the presidency - Ken Agyapong alleges
- How a Nigerian entrepreneur built a non-existent US$1 billion company
- Read all related articles