BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

Omoyele Sowore announce brother death to suspected herdsmen / kidnappers attack

 120390943 58447739 Omoyele Sowore be journalist and politician

Sun, 5 Sep 2021 Source: BBC

Nigerian activist and former presidential candidate, Omoyele Sowore confam di death of im brother Olajide Sowore on Saturday,

For inside statement, e tok say herdsmen/kidnappers reportedly shoot and kill im immediate younger brother near Okada town for Edo State.

“Olajide bin dey on im way from Igbinedion University for Edo state wia im bin dey study Pharmacy”, Sowore tok.

“Dem sniff di life out of am, yet anoda real human being!. Rest in Power, Dr Mamiye!”

Di activist describe im brother as ‘an out-of-the-box thinker’ wey bin first decide say school no be for am and create im own genre of music but later change im mind to go school wen im almost don turn 50.

“I travel widely wit you and our papa wen we be little kid. You be di most loved robust kid I don eva first sabi. You, Mr. magnet no get any enemy!

You, Mr. Sunshine Foundation wey dey make everybody happy.

You, di boy wey go sneak im older ones to parties and take all di blames wen our disciplinarian papa don find out.

You bin live your life make everibodi for dey alright but now, everitin wey no dey alright don kill you.

Dis act in itself no go delay dia day of justice.” Sowore tok.

Cases of banditry, kidnap and herdsmen palava don dey recurrent for Nigeria, even though authorities don tok say dem dey do everything within dia power to stop di menace.



Read full article

Source: BBC