BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

Reports say dem don shoot dead American rapper Takeoff for Houston

Skynews Takeoff Migos 5950734 American rapper Takeoff

Tue, 1 Nov 2022 Source: BBC

Dem don shoot and kill American rapper Takeoff, from di chart-topping band Migos, for Houston, accord to wetin US media dey report.

Police tell tori pipo for Variety magazine say dem kill di rapper for one bowling alley wia im bin dey play dice wit im uncle and bandmate, Quavo, on Tuesday morning.

Di star, wey im real name na Kirshnik Khari Ball, be 28 years old.

Migos na one of di most influential groups of dia generation, pioneering a style of rapping for choppy, staccato triplets wey pipo sabi as di "Migos flow".

Di band, wey split earlier dis year, don gbab plenti international hits including Bad and Boujee, Versace and Walk It Talk It.

Di shooting happun at about 02:30 local time (07:30 GMT) for one balcony outside di 810 Billiards and Bowling Alley.

Police say 40 to 50 guests bin dey one private party wen one pesin open fire. Security guards for di area hear di shots but im no see who open fire.

Wen dem arrive di scene, officers say dem see one large crowd and a man in im twenties wit a gunshot wound to di head or neck.

Dem pronounce am dead at di scene.

Media outlets including TMZ, Variety and di Hollywood Reporter identify Takeoff as di victim.

Meanwhile, police tell di BBC dem neva fit officially confirm an identity until dem notify di family. Spokespeople for Takeoff and di group neva respond to requests for conformation.

Takeoff bin don earlier post fotos of imself for di bowling alley to Instagram. Fotos from di crime scene wey pipo share on social media appear to show one man wey lie down on di ground dey wear di same kain clothes.

Reports say Quavo also dey for di scene of di incident but we neva fit confam am.

Police say dem don drive two oda victims to hospital in private vehicles.

 



Read full article

Source: BBC