BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

Top Kenyan runner Agnes Tirop bin murdered, husband be suspect

 121069462 916b6691 681d 4b08 A1b4 02d9a798f982 Agnes Tirop

Wed, 13 Oct 2021 Source: BBC

25 year old Kenya world record holder, Agnes Tirop don die.

Dem find her dead for her house for di western town of Iten, one training hub for many athletes.

Di two-time World Athletics Championships bronze medallist bin represent her kontri for di recent Tokyo Olympics Games and she finish for fourth position.

Sources tell BBC say dem found Tirop dead wit stab wounds on her belle.

Lat month, Tirop set di world record for women's only 10km race for Germany.

Kenya President, Uhurru Kenya don mourn di death of di Olympian and order police to quickly find and arrest criminals wey dey responsible for her death.

Wetin Police tok

Police say her husband don go missing afta her death.

On Wednesday, crime scene investigators land di house of Tirop, where police say was reported missing by her father on Tuesday night.

Athletics Kenya, di body wey dey in charge of di sports for athletics (tracks and fields, marathon, road, races and cross countries) for Kenya say na her husband allegedly stab her.

Di governing body inside statement say di death of Tirop shock dem as Kenya don lost one of im fast rising athletic giants on di international stage.

"We still dey work to get more details surrounding her death,"

Her last race wey she run last week before her death na di 2021 Valencia Half Marathon wey she finish in a set time of 30:20.

Who be Agnes Tirop

Agnes Jebet Tirop na Kenyan Professional long distance runner wey dey compete mainly for inside 5000 meters and cross country running.

She start her career as junior athlete for 2011.

Tirop win two bronze medal for di 5,000m for that year world junior championships.

Four years later, she win di senior World Cross Country championships for China - wey make her become di second youngest medallist for that level.

She win Africa Cross Country for 2014 for Kampala, Uganda plus di World Junior Cross Country Championshionship for Bydoszez, Poland for 2013.

For 2017, she win bronze medal for di 10,000 metres event, same thing for 2019 where she win bronze medal for di World Athletics Championship.

For di 2020 Olympic Games wey hold for August, Tirop finish just outside di medal places for di women's 5,000m. She follow afta Ethiopia bronze medallist Gudaf Tsegay by 0.75 seconds.



Read full article

Source: BBC