BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

Wetin to know about US Midterm elections wey go happun on Tuesday

US Polls Midterm Elections Di 2022 midterm elections for US

Sun, 6 Nov 2022 Source: BBC

Di United States go hold dia midterm elections for 8 November 2022.

Di results of di election go affect di res Joe Biden presidency and afta sef.

Wetin be di midterms and who dem dey vote?

Di elections na for di Congress wey include di House of Representatives and di Senate.

Dis elections dey hold every two years and when e fall for di middle of di president four year term, dem dey call am midterms.

Congress dey nationwide laws. Di House dey decide whicj laws dem dey vote on while di Senate go come block or approve dem, confam appointments wey di president make and for rare occasion fi investigate a.

Each state get two senators wet dey sit for six year terms. Representatives dey serve for two years and dey represent smaller districts.

All di seats for di House of representatives dey up for dis election for November and na one-third of Senate dey compete.

Several major states dey follow do govnorship election and well as local officials.

Who fit win?

Di Democratic Party don hold majority for both di House and di Senate for di past two years. E epp President Joe Bidemn to pass di llaws wey im wan pass.

But di Democrats dey hold dat lead by tintini margin wey make di contest tight. Polling show say Republicans fit take di House but Democrats fit maintain di Senate.

For di 435 HOuse seats, most dey safe by di party wey hold dem, na like 30 fit cause wahala. Areas wey dey around cities for states like Pennsylvania, California, Ohio and North Carolina go be di koko.

For di Senate, na four out of di 35 seats wey dem dey contest for fit go to either party. Dem be Nevada, Arizona, Georgia and Pennsylvania.

Wetin be di issues wey be koko?

For di beginning of 2022, e be like di biggest issues go be immigration, crime and di cost of living, wey for give conservative Republicans edge for votes.

But e tumble for June wen di US Supreme Court overturn di national abortion protections wey give boost to Democrats, as na dem dey support women rights to choose and don make di koko of dia campaign.

But as di immediate impact of di decision don dey calm down, Republicans dey tr to bend focus go inflation, immigration and violent crime.

Wetin di results go affect?

Dem dey use midterms judge how di president do, and di party wey dey White House dey lose seats. Dis na wetin go worry President Biden as im approval ratinf among voters don dey under 50% since August.

Id si Democrats fir hang on, President Biden go fit continue with im plans for climate change, expand goment run healthcare programmes, protect abortion rights and tighten gun control.

If di Republican take control of either of di chamber, dem fit match brake on dat agenda.

Dem go fit also control investigatory committees wey fit end inquiry into di 6 January 2021 on US Capitol by former President Donald Trump supporters even though dem suppose finish dat work by di end of di year.

Dem fit start new investigate into tins like, JOe Biden pikin Chinese business dealings or di sudden withdrawal if US troops comot Afghanistan.

E go dey harder for oga Biden to make new appointments like to di US Supreme Court, foreign policy, especially help to Ukraine as dem dey fight Russian invasion.

Like dat too, Biden fit use im veto power block conservative laws on abortion, immigration and taxes.

Dis mean say governance go jam hold up till di next presidential and congressional elections.

How dis election go affect di 2024 presidential race?

Di midterms fit allow us peep who fit run as Republican presidential candidate for 2024.

If di candidates wey oga Trump dey support do badly, e dey more likely not to get backing by di Republican party to run again. For Florida and Texas, Republican govnors Ron DeSantis and Greg Abbott dey hope for re-election so e go ginger dia bid for di White House.

If di Democrats fit hold power for Michigan, Wisconsin, and Pennsylvania, dat fit give dem ginger as dem dey arrange for dia 2024 campaign to get President Biden second term.



Read full article

Source: BBC