BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

We no ban travellers wey never get COVID-19 vaccine - Nigeria Civil Aviation

 107986826 54512098 1678344878977695 222349100731892535 N Air Peace jet as im dey arrive for one airport

Fri, 1 Oct 2021 Source: BBC

Di Nigerian Civil Aviation Authority (NCAA) don deny tori say di federal goment bin direct say make travellers wey no get proof of vaccination no go enta plane.

Dem tok dis one for inside statement say dem no get any of dat kain directive from di Federal goment through di join bodi.

Dis na afta tori start to dey go round say the ban on pipo wey no get "proof of vaccination" to travel go start for December.

Howeva, dem tok say dem still dey work with di Federal Goment to reduce di way di Coronavirus Delta variant dey spread.

Dis statement dey come even as di Presidential Steering committee on Covid 19 say dem dey expect 3.5 million doses of Pfizer vaccines to land di kontri soon.

But NCAA say wetin dey dey check on for now na to make sure say pipo follow safety protocols like wearing of facemask, washing of hands, avoiding crowded spaces, using hand sanitizer wey dey alcohol-based and maintaining social distance.



Read full article

Source: BBC