BBC

News

Entertainment

Sports

Business

Africa

Live Radio

Country

Webbers

Lifestyle

SIL

Ghana Police dey on manhunt for suspect wey kill girlfriend den put am for fridge inside

 121762037 03f08314 A65c 4da2 973b 583d3d236003 Police cari di corpse from di crime scene

Tue, 23 Nov 2021 Source: BBC

Ghana Police say dem dey on manhunt for boyfriend who allegedly murder en girlfriend, dump am inside fridge for House.

On Monday, residents discover de body after neighbours of de young man notice bad stench from de man en room.

Witnesses say dem see as flies full ground around de window and door of de room of de young man police call 'Frank'.

Sake of dat, dem break into de room discover de decomposing body of de girlfriend of de male tenant inside double-decker fridge.

De neighbours alert police who take over de crime scene for investigations.

According to Volta Refional Police PRO ASP Efia Tenge, "upon careful examination of de crime scene, dem carry de body which dey advanced stage of decomposition go morgue for autopsy."

Neighbors identify de dead girlfriend only as Lizzy, but police say dem no dey see de whereabouts of suspect, Frank.

"Search dey underway to trace and arrest de said boyfriend who dem feel say kill de lady" she add.



Read full article

Source: BBC
Related Articles: